A lawyer and pesin wey dey fight against abortion don sama accuse give di ogbonge organisation for bodi mata for obodo world plus di ogbonge ministry of bodi-mata for we kontri, say dem dey promote abortion.
For di 6th Episode of #TalkingHealthwithDrLaz, three ogbonge sabi people for health matter talk say plenty people dey make wrong diagnosis of typhoid for we country because na wrong test dem dey do. Di correct test na...
Di full video of Episode 004 of your ogbonge health programme inside Television - #TalkingHealthWithDrlaz dey here. If you miss di programme, you fit watch am here; https://www.youtube.com/embed/ZF0DKIK-RZ0
For di Episode 004 of #TalkingHealthwithDrLaz wey show yesterday evening inside Africa Independent Television (AIT), Head of Department of Obstetrics and Gynaecology inside Uniabuja Teaching Hospital Gwagwalada bin follow Dr. Laz Eze talk about Family Planning. Him...
Episode 003 of our TV show on AIT bin talk about bone things and emergency medical services. Na Dr Adeoye Adetiloye be our guest. He na expert doctor for bones matter.
https://www.youtube.com/embed/mu5c4fSK3JU This na di 1st episode of #TalkingHealthwithDrLaz inside Africa Independent Television (AIT). No miss am o, na every Tuesday 6.30pm.
Di #MakeOurHospitalWork Campaign don carry big tuale give Daar Communications and TalkHealth9ja for di new health program dem go start on Tuesday 18th August 2020, wey dem call #TalkingHealthwithDrLaz. Dem hail di presenter of di program, Dr...
No be small thing o, di kind happiness, hailing and jollification wey Naija people dey show about di new health show for AIT - TalkingHealthwithDrLaz no be here. Na We and Daar Communications dey produce di programme...
Next Tuesday na a day of history as TalkHealth Real Media Limited (publishers of TalkHealth9ja.com) and Daar Communications PLC (owners of AIT and RayPower FM) don join bodi to produce a tear-rubber health show wey go dey...