Home As e de hot Behaviour Change Na di Koko – Prof. Ali Pate

Behaviour Change Na di Koko – Prof. Ali Pate

436
0
Coordinating Minister of Health and Social Welfare, Nigeria

Di Coordinating minister for Health and Social Welfare, Prof. Muhammad Ali Pate na eim yan dis one on Thursday for di Breakthrough ACTION Nigeria Learning and Transition Event wey happen inside Abuja. Prof. Pate yan dis one through Dr. Binyerem Ukaire, wey be director of family health for Federal Ministry of Health (FMOH),wey represent am for di ogbonge event.

Di event celebrate di achievements of Breakthrough ACTION, a project wey USAID dey carry plenty akpala kpala dey support inside obodo naija for di past seven years. Di program follow serve as ginger for more innovation, collaboration, and progress to take helep make  health better for country pipo.

Prof. Ali Pate carry plenty twale give Breakthrough ACTION Nigeria’s (BA-N) for di kajad work work wey dem dey do for health communication and social behavior change, say the project don reach millions of Nigerians, and e don make dem dey practice better health habits, and empower communities with important health knowledge.

Di ogbonge minister give plenty hailings to Breakthrough ACTION Nigeria for di impact wey dem work don produce for different areas, including disease prevention, reproductive, maternal, newborn, and child health, as well as nutrition.

Pate  say di ministry of health no go taya to make sure say every Nigerian dey kakampe, and eim note say the collaboration with Breakthrough ACTION Nigeria show di power of working together to achieve national health goals, and eim recognize the importance of di event.

This material is produced for the Media EIS Fellowship program, a collaborative partnership among the Nigeria Centre for Disease Control and Prevention, the USAID funded Breakthrough ACTION Nigeria and the African Field Epidemiology Netwrok.

LEAVE A REPLY

Please enter your comment!
Please enter your name here

This site uses Akismet to reduce spam. Learn how your comment data is processed.