No be small thing o, di kind happiness, hailing and jollification wey Naija people dey show about di new health show for AIT – TalkingHealthwithDrLaz no be here. Na We and Daar Communications dey produce di programme wey go dey show every Tuesday by 6.30pm. Dr. Laz Eze na di presenter and co-producer.
Since we post am for our different social media accounts on facebook, twitter and instagram, people just dey happy say e don tey dem dey expect to see doctor wey go dey do health program for Naija TV. Dem hail African Independent Television (AIT) and TalkHealth9ja for bringing sabinus doctor to educate kontri people more about health. Ogbonge public health doctor, Dr Nkata Chuku talk for twitter say di show dey “timely”.
Plenty people and organisations bin write many comments for inside facebook page of Dr. Laz Eze dey hail am for di initiative. Dem say dem no go miss am as e go help educate plenty kontri people.