For di 6th Episode of #TalkingHealthwithDrLaz, three ogbonge sabi people for health matter talk say plenty people dey make wrong diagnosis of typhoid for we country because na wrong test dem dey do. Di correct test na culture of di bone marrow, blood, stool or urine Dem also talk say plenty kontri people dey abuse antibiotics because of di wrong diagnosis and e dey make bacteria dey form levels for di drugs. . Di 3 guests for di programme na Dr Chukwuemeka Anya – sabinus for disease wey dey port from pesin to pesin, Ms Abigail Anugengen – medical laboratory scientist and Onimisi Peter, PharmD wey be pharmacist.
All di tori dey for inside dis video. Watch am and yan us wetin you learn.