Home Uncategorized Gender-Based Violence Dey Kolobi Women Mental Health – NGO

Gender-Based Violence Dey Kolobi Women Mental Health – NGO

588
0

To observe di sixteen days of activism against gender-based violence, Vaccine Network for Disease Control don talk say violence gainst women dey yab their mental and psychological health well-well for Naija. Dem yan dis important matter during di event wey dem organise for LEA Primary School, Iddo Sarki, Abuja, wey happen last Friday.

Inside dis event, dem officially launch di Community Protection Committee, wey be group of people for di community wey dey helep address any matter wey consign violence against women and other wahala wey dey di community. 

Franca Aide, wey be di project coordinator and Protection officer for Vaccine Network for disease control, talk say dem do dis event sake of tori wey dem don hear about gender-based violence for Iddo community and to take helep reduce di health problem wey e dey cause women..

“Dis event na to torchlight di community about gender-based violence and how di community fit helep stop am, especially as e dey affect women,” Ms. Aide talk. 

She talk say e dey important make organizations like their own (Vaccine Network for Disease Control) and communities waka hand in hand to take solve plenty problems wey dey affect communities,  and na cos of dat naim make dem setup of Community Protection Committee.

Members of dis committee include di Iddo Sariki

Mrs. Adedayo Benjamins-Laniyi, wey be di mandate Secretary for Women Affairs Secretariat of di Federal Capital Territory Administration (FCTA), support di event and promise to dey support women and girls for FCT. 

Di headmistress for Iddo Sarki LEA Primary School, Mrs. Dauda Sarah, hail Vaccine Network for di beta work wey dem dey do. She yan say di organization dey helep dem wella, even dey pay Parent-Teacher Association (PTA) for their pikins.

LEAVE A REPLY

Please enter your comment!
Please enter your name here

This site uses Akismet to reduce spam. Learn how your comment data is processed.