Presido Bola Ahmed Tinubu don yan say his administration dey carry health for head to take make di health sector dey chim chim. Him yan say him dey do dis one through di investments and allocation for di health sector inside di 2024 budget according by a press release by di special adviser to di president Chief Ajuri Ngelale, Special Adviser to the President on Media and Publicity.
Oga Presido talk dis one for di unveiling of di Nigeria Health Sector Renewal Investment Initiatives plus di signing of di Health Renewal Compact by di Federal, States Governments and Development partners for Abuja on Tuesday.
Di event na part of activities wey mark di Universal Health Coverage (UHC) Day wey every country for obodo world dey observe on di 12th of December.
“I promise Naija people say we go get better health, and today, that promise don land with the support of all our multilateral partners and agencies. Health dey now on top the matter, we dey gidigba!”
“Dis event na chance for all of us to reason and waka the talk as we renew our commitment to make health beta for everybody. The theme for dis year, ‘Health for All: Time for Action,’ dey talk say time don reach to act with serious ginger to achieve dis important goal.
“Health no be only when pesin no dey sick. E be like complete package wey include body, mind, and how pesin dey connect with community. Na correct human right, and my government serious well-well to make sure say every pesin, whether na young or old, whether e dey town or village, fit enjoy dis right.
“We dey gree say, health for everybody na must-do, and we go make sure say we cover everybody with beta health, no shaking.” di President talk.
To handle how health dey cost, President Tinubu talk say dem go shake Basic Health Care Provision Fund (BHCPF) well. Dem go change am to make sure say everybody fit chop better healthcare as di National Health Act (2014) talk.
Him talk say as dem dey do all dis better work, make everybody join hand, no dey partisan for di coordination and how dem go run am.
Prof. Muhammad Ali Pate, wey be di Coordinating Minister of Health and Social Welfare, talk say dem redesign BHCPF as di main thing wey go dey run di whole sector. E talk say dem dey plan to pump at least 1% of di Consolidated Revenue Fund, wey go bring reach $2.5 billion from 2024 to 2026, to jinja di primary health system all over Naija.
Him still talk say dem get plan to double di number of beta Primary Healthcare Centres (PHCs) from 8,809 to 17,618 by 2027 for all di 36 states plus di Federal Capital Territory (FCT). E add say dem go connect dis PHCs with serious emergency care system.
He come talk say, ‘make we all see road,’ e talk say di government go dey transparent with how dem dey use resources, release money, and di results wey dem dey get. Dis one go carry everybody along, government bodies, non-governmental partners, civil society organizations, and even we wey be citizens.
Him still talk say di government don show serious political will with di increased money wey dem plan for di 2024 budget for health and social welfare sectors. E talk say Tinubu government dey serious to make Universal Health Coverage (UHC) happen and to make Naija people health beta.
Prof. Pate still talk say, ‘we thank Mr. President,’ as di Federal Government dey put big money for health infrastructure and equipment for our hospitals. Dem dey also bring beta things wey hospitals need, expand health insurance, plus dem dey focus well-well on di welfare of health workers.
For di way wey medicine cost dey rise, Prof. Pate talk say di government plan to put setup for how dem go buy medicine together (pooled procurement) for 2024. Dis one go reduce cost and make sure say di medicine wey dey important dey available, plus e go make am cheap for poor Nigerians to buy.
“In di short-run, Mr. President get plan for health, e go make Naija fit produce more of di drugs wey dem dey use, medical devices, and oda important things like vaccines. Dis one go make we no dey depend too much on people wey just wan use our market.”