Home Uncategorized Presido Tinubu Approve Establishment of Health Fellows Programme

Presido Tinubu Approve Establishment of Health Fellows Programme

362
0

For him strong desire to make better primary healthcare centers wey dey ground and to build more than 8,800 new ones for all local goment areas for di kontri beta, Presido Bola Tinubu don agree say make dem start National Health Fellows Programme. Dis dey come from a press release wey Chief Ajuri Ngelale, wey be di Special Adviser (Media and Publicity) to Oga Presido bin sign.

Young Nigerian fellows go work for all di 774 local goment areas for di kontri. Di well-trained fellows go be like watchdogs wey go dey monitor and check how Primary Healthcare Centre dey grow and perform. Dem go dey check how the money take enta di centres across di kontri.

Di fellowship programme go dey with the Sector Wide Approach (SWAp) coordination office wey dey under di Federal Ministry of Health and Social Welfare. Dem go recruit, pay and give di fellows tools wey dem go use track di performance of Basic Health Care Provision Fund-supported health facilities across di kontri.

Presido Tinubu, wey be African Union Champion for Human Resources in Healthcare, believe for young Nigerians and expect say their involvement for dis important nation-building work, wey include to dey monitor and track health reforms for their areas everyday, go bring better service to all Nigerians for every part of di kontri.

LEAVE A REPLY

Please enter your comment!
Please enter your name here

This site uses Akismet to reduce spam. Learn how your comment data is processed.