Inside di matter wey consign access to healthcare for Naija, poverty still dey yan strong for di matter. E be like say e be ogbonge set back for plenti pipo wey no fit waka go hospital sake of di plenty plenty moni wey dem go need to pay for healthcare services.
Even as we get di National Health Insurance Authority Act of 2022 wey talk say make everybody get health insurance. Di wahala no get part 2 as plenti pipo for hard to reach communities no dey fit get healthcare services wey dem need cos of sapa.
Madam Chika Offor, wey be di Founder of Vaccine Network, talk say poverty na serious matter and dat follow for wetin make her organisation dey work hard to take helep naija achieve Universal Health Coverage by 2030.
As she yan during their act of service program for Iddo Sarki community for Abuja on Friday, she talk say, plenti pipo no get money to go hospital but if dem get health insurance e go make am easy for dem, still come make am easy for naija to achieve di health coverage for all.
Di theme for dis year Universal health coverage day wey dey happen on di 12th of December every year na “Health for all: Time for Action.”
As organisation wey dey work with communities to take solve problems like access to healthcare services,HIV, gender based violence plus vaccine hesitancy dem initiate di act of kindness program to take reach di hardest to reach pipo for inside communities across di kontri.
One woman wey benefit from di Act of Kindness, Mrs. Hauwa Ibrahim, yan how e hard for her to get healthcare sake of no money.
To show dis kindness Vaccine Network come helep renovate di woman house, come furnisham with beds, mosquito nets to take prevent malaria plus better better other things wey dem take helep life.
Mrs. Hauwa come carry plenty hailing give Vaccine Network for di better things wey dem do for her and her pikin most improtantly now she fit sleep under mosquito treated net wey go make her and her pikin no get malaria again, dis go follow helep reduce di money wey she dey spend to dey buy malaria medicine for chemist..
Vaccine Network Community volunteer, Mr. Brutus, yan say e no easy for poor pipo to waka go hospital. According to am, fear dey catch dem sake of di plenty moni wey dem dey ask for hospital. As dem no fit waka go, dem go rather waka go chemist go buy medicine for disease wey dey do dem. Mr. Brutus come beg ogbonge government say make dem try be talk na do government, as dem don yan for National Health Insurance Authority Act say insurance dey mandatory for all kontri pipo make dem try do am make e no be say na for paper alone.
For di mata, make we waka shine eye and make our bodi health important. Na di koko thing wey we get for dis life.
Tuale to Vaccine Network for di better things wey dem dey do for Iddo Sarki community to helep Naija achieve beta health for everybody.