As obodo world dey focus on Coronavirus #Covid-19, Lassa Fever no dey rest o. According by the week-by-week update wey the Nigeria Centre of Disease Control (NCDC) publish on 15th March 2020, Lassa Fever don infect 51 new Nigerians and killed 9 more people. If you check am from 1st January 2020 till 15th March, Lassa Fever don infect a total of 906 Naija people and killed 161. This one mean say confirmed Lassa Fever cases na 113 times that of Coronavirus Covid-19.
Although Lassa Fever don affect people for more than 25 states, Na Ondo, Edo and Ebonyi States dey on top with highest cases of this killer disease. If you wan read more about the Lassa Fever week-by-week updates, make you click here shaperly.
[…] See the tori we bin do 2 weeks ago wey Lassa Fever dey boast for Coronavirus here. […]