For di past 17 years, April 25th, na special day wey we dey take mark di efforts wey don government and NGOs for obodo world don put to stop malaria, and also dey find better ways to quicken di pace for di fight against dis sickness wey don kill plenty women and pikins pass any other disease for Africa.
Vaccine Network for Disease Control, as part of dia intervention, carry sensitisation and awareness program enter Gosa Primary Healthcare center on Thursday to commemorate di World Malaria day.
Faith Ojochenemi Adukwu, wey be di program officer at Vaccine Network for Disease Control , while talking with TalkHealth9ja yan say, as an organisation dem don dey work to see say malaria end for naija. She yan say e dey very importamkpa say pregnant women and women wey just deliver dia pikin dem sabi wetin dem gats do to take protect demselves plus dia new pikin dem from malaria. Ms. Faith yan say, dem dey share insecticide treated net to take helep clear malaria kpata kpata for naija.
Ms. Phoebe Ifeanyinachukwu, wey be di RI manager for Gosa Primary Healthcare Center, talk say di best way to stop malaria na through awareness. She tell di women say make dem dey always remember to clean dia environment clean and to dey sleep inside the insecticide treated nets wey Vaccine Network for Diseas Control don share for dem.
She come take her time explain to di women how dem dey take use the net
One nursing mother wey benefit from di intervention, Mrs. Aisha Danjuma, appreciate di effort wey di organisation don put, and thank dem for di mosquito nets wey dem give dem. She talk say di net go helep am save plenti money, because di cost to buy net dey high and di cost to treat malaria for dis economy no be beans.
She talk say, “If pesin no get mosquito net, e sure for am say e go sick with malaria every three weeks, but dis net go helep me and my family save plenti money.”
Make we join hands end malaria for we country.