Home As e de hot WHO don Approve new Cholera Vaccine

WHO don Approve new Cholera Vaccine

315
0

Gavi and UNICEF don hail WHO for approving di new oral cholera vaccine, Euvichol-S. Dem talk say dis go make EuBiologics, di producer to fit make plenti vaccine quick quick, wey go helep stop di cholera wahala wey dey disturb people for obodo naija. According to dem, dis approval go make like 50 million doses of di vaccine dey available dis year, pass wetin dem get last year.

Cholera don dey cause serious gbege since 2021, plenti people dey die from am even though we get simple treatment wey dey work. Di plenty outbreaks don make countries dey beg for vaccine.

Dr. Derrick Sim, di Managing Director of Vaccine Markets & Health Security for Gavi, talk say dis vaccine na like life rope wey dem throw give people wey dey suffer from cholera.

Leila Pakkala, di Director of UNICEF Supply Division, follow yan say even though we fit prevent and treat cholera easy, pikin dem still dey suffer from am.

Di Euvichol-S vaccine na product of partnership between EuBiologics, di International Vaccine Institute (IVI), and di Bill and Melinda Gates Foundation. Dis na good news for di world as we dey try fight dis deadly disease.

LEAVE A REPLY

Please enter your comment!
Please enter your name here

This site uses Akismet to reduce spam. Learn how your comment data is processed.