Home As e de hot We Go Join Hands Share Resources and Put Eye for Health Expenditure...

We Go Join Hands Share Resources and Put Eye for Health Expenditure – Stakeholders

480
0

How to hold government accountable for di akpala kpala wey dem collect and make sure say dem dey spend am well na serious mata wey dey affect health service delivery for obodo naija. Stakeholder yan dis one for di one day Technical Review meeting wey Vaccine Network for Disease Control been organise for Abuja today in partnership with GemHub Initiative, Health Reform Foundation of Nigeria plus sponsorship from Africa Health Budget Network (AHBN) 

Chika Nwankwo, di Head of programmes for Vaccine Network for Disease Control, yan say dem dey aim to know wetin dem use health budget money do, and track am wella using ogbonge systems wey don dey ground for health, security, and even COVID-19 vaccine for Naija.

Ms. Nwankwo talk say di reason why dem join body na to checkmate all di signs wey dem don track so far, join am togeda, see wetin dem go add or comot make dem get better way to hold government accountable, and make sure say different government agencies follow the plan wey dem set.

Nwankwo still talk say, sometimes di main wahala no be say dem no wan do the work wey dem plan, but na because dem no dey get di money on time to do am.

She talk say, “E dey importamkpa for us to check if dem dey release di money on time, because when we go meet these government people, we go see say dem no dey do wetin dem suppose to do, no be because dem no want to, or because dem no sabi, but because dem no see di money on time.”

So, dem dey look into all these things to make sure say dem fit follow di correct way on how dem go release di money on time, especially for state level. 

Dr. Opeyemi Adeosun, wey be di Programme Manager for Health Reform Foundation of Nigeria (HERFON), talk say this collaboration no be only to join hand on top the current system wey dey ground, but also to add more signs to track other activities apart from just money, dat Naija go fit get health security wey dey kajad.

Adeosun dey call on everybody to work with the government and ask dem the right questions, so that dem go fit do the right thing well well.

He yan say, di same energy wey people use follow government directives during COVID-19, make dem use am now too, because as citizens, e dey their hand to protect demselves, and to show government say dem dey watch dem actions.

Dr. Adeosun still talk say, only when di government see say citizens dey interested for their work, na dat time dem go feel say dem need to show accountability.

He even call on government to make health security serious, so that people no go dey die anyhow for Naija.

LEAVE A REPLY

Please enter your comment!
Please enter your name here

This site uses Akismet to reduce spam. Learn how your comment data is processed.