Home As e de hot University College Hospital Ibadan: Light No Dey, Doctor Dey Cry.

University College Hospital Ibadan: Light No Dey, Doctor Dey Cry.

545
0

Dr. Laz Eze don call on di Ministry of Health and di government of Nigeria to helep restore power to di University of Ibadan Teaching Hospital. Him talk dis one for inside one interview wey him do for News Central today. E dey very important to note say, Ibadan Electricity Distribution Company (IBEDC) yan say di teaching hospital dey hold gbese wey don reach 400 million naira for light bill and cos of dis dem come disconnect light from di hospital.

Di Ogbonge sabinu wey go viral recently as him discover new river “Iyi Ogwe” for Ireland, yan say di light wey no dey for di hospital dey affect research plus other medical activities wey suppose dey happen for hospital.

Dr. Eze don talk say di matter no be only students, e dey affect, e dey affect health research plus di well being of patients and doctors. Him come advise say managers suppose dey think about how dem go fit get financing measures wey go last to take handle di matter wey concern inflation.

Him yan say: “Apart from students, dis matter dey affect health research gidigba. Every manager suppose put eye for sustainable financing measures to tackle inflation. Hospitals suppose find other ways to make money wey go last for long.”

Dr. Eze say make government helep solve di problem sharpaly sharpaly.

LEAVE A REPLY

Please enter your comment!
Please enter your name here

This site uses Akismet to reduce spam. Learn how your comment data is processed.