Di oga madam for National Senior Citizens Centre for obodo Naija, Dr. Emem Omokaro don show way to pipo wey get mouth on top brain health mata for we kontri. During her talk as ogbonge speaker for brain health policy on Thursday 28th March 2024, she say brain health and mental health no be di same. She ask some questions wey brain health advocates suppose reason, and things dem suppose do as dem dey engage other stakeholders and policymakers. As National Mental Health Act and National Mental Health Policy don dey ground, Dr Omokaro yan say the development of a national strategic plan for dementia na correct thing to do.
Na di Alzheimer’s Disease Association of Nigeria (ADAN) and the Sub-Saharan Africa Brain Health Initiative (SSABHI) bin organise di conference, and we for TalkHealth9ja follow support am.