Home As e de hot Brain Health Policy: See Advice wey b4b4 Minister, Iyom Josephine Anenih Give...

Brain Health Policy: See Advice wey b4b4 Minister, Iyom Josephine Anenih Give Government

693
0
Iyom Josephine Anenih

For dis afternoon, more than 100 people wey mata of brain health dey give sleepless nights for we kontri gather talk matter of policy, guideline, plan or even law wey go help make mata wey dey affect brain dey chimchim for we kontri. One of di ogbonge pipo wey give talk na Iyom Josephine Anenih we be b4b4 minister of women mata, and now Founder & Oga for Alzheimer’s Disease Foundation. She talk say plenty more pipo dey grow old these for we kontri than before. She con advise government for federal and state make dem make plan wey go helep senior pipo to jolly their life inside old age.

The gather na wetin dem call Brain Health Policy Conference in Nigeria. The organisations wey arrange am na Alzheimer’s Disease Association of Nigeria (ADAN) and the Sub-Saharan Africa Brain Health Initiative (SSABHI). We sef for TalkHealth9ja follow give dem support o.

LEAVE A REPLY

Please enter your comment!
Please enter your name here

This site uses Akismet to reduce spam. Learn how your comment data is processed.