Home MakeOurHospitalWork Presido promise One Bread but na only Half Health Sector go Chop...

Presido promise One Bread but na only Half Health Sector go Chop from 2024 Budget

565
0
Oga Presido Tinubu

Di saying of half bread better pass nothing don become true for Naija health sector as Presido Tinubu present 2024 Budget last week. Inside di budget, ogbonge government for obodo Naija wey grammar people dey call Federal Government plan to spend N1.33 trillion on top health matter for 2024, according by di detail of di budget wey Budget Office komot. Of dis money, Ogbonge bodi-mata ministry and all di agency wey dey under am go spend N1.07 trillion, immunization go chop N137.21 billion while N125.74 billion na for di Basic Health Care Provision Fund. Assuming the N27 trillion total 2024 budget na 10 full loaves of bread, Presido bin promise say health sector go chop one full loaf but na half loaf kom reach di sector now.

Plenty health advocates don dey para dis amount no meet di promise of 10% (N2.66 trillion) wey oga presido bin make to kontri pipo through im Special Adviser on Health, Dr. Salma Anas Ibrahim. See di tori here. Wetin kom happen? As budget dey before lawmakers dem, they fit upgrade am to one loaf of bread?

LEAVE A REPLY

Please enter your comment!
Please enter your name here

This site uses Akismet to reduce spam. Learn how your comment data is processed.