Home Things wey happen Totoriment of Hearts All Over Naija as 8 Medicos Show African Mates...

Totoriment of Hearts All Over Naija as 8 Medicos Show African Mates Levels for FAMSA Quiz Competition

1402
0
EBSU Reps wey carry 3rd position

Congratulobia, tuale and totriment of hearts dey fall like heavy rain on top di head of di eight medicos from di University of Benin and Ebonyi State University as dem trash more than 40 other schools inside Africa for di FAMSA Inter-MSA Quiz Competition. FAMSA na di join bodi of all di medical students associations inside obodo Africa wey don dey exist since 1968. Tori wey reach us show say dem organise quiz for over 50 medical students associations from about 15 kontri.

Na Naija medical schools plenty pass, and of 6 of dem wey reach finals, 5 na from Naija. But as e come be, na Kabale University Medical Students Association for Uganda come win the quiz, di 4 reps of University of Benin Medical Students Association (UBEMSA) follow dem for back while di 4 reps of Ebonyi State University Medical Students Association (EBSUMSA) carry 3rd position. People don dey share di photo of some of di winners dey give dem tuale inside social media.

TalkHealth9ja get better and trusted informate say one House of Rep member from Ebonyi State get better reward to one of im constituency member wey follow represent EBSU. We go bring detail tori later.

See as FAMSA take publicize di quiz.

LEAVE A REPLY

Please enter your comment!
Please enter your name here

This site uses Akismet to reduce spam. Learn how your comment data is processed.