Di National Agency for Food and Drug Administration and Control (NAFDAC) don yan say dis two medicine wey dem dey use spread to kill grasses (Agrochemical) dey dangerful for we health.
Di oga madam for NAFDAC, Prof. Christianah Mojisola Adeyeye na she yan dis one for one announcement wey dem make through dem official Twitter (X) handle. She yan say di medicine Atrazine, wey kontri pipo dey use control grasses for maize, sorghum, and sugar cane dey affect di reproductive system, endocrine system and still get power to cause cancer for human being.
She come follow yan say, many kontri don ban Atrazine cos of di negative effect wey e get for vegetables and e follow for wetin make di European Union kontris no dey accept our vegetables dem. She come yan say make kontri pipo stop to dey use am for di sake of deir own health. Anoda drug wey di agency ban na Colistinin. Colistin na antibiotic wey dem dey use treat sickness animals like rabbits, poultry, goats and pigs. Di agency yan say dem don ban dis medicine.