Dr. Bolanle Okunowo, wey be consultant endocrinologist for Lagos State University Teaching Hospital, don yan say if pesin no gree breastfeed pikin well and dem dey use plenty artificial milk, e fit increase di chance wey pikin go get type 1 diabetes.
Dr. Okunowo talk say if pikin dey chop too much artificial milk wen e dey small, e fit make di pikin bodi carry chemical substances wey fit make di pikin dey get diabetes later.
She talk say make women try breastfeed dia pikin well for di first six months and dem fit still dey breastfeed dem for up to two years join as dem dey chop odas.
Di endocrinologist also yan say e good make schools get big space wey go fit make pikin dey run up and down so dem no go get problem of obesity and diabetes. She talk say e dey pain her as schools no get enough space again wey fit helep pikin dey active and no go get problem.