Dr. Ifedayo O. Adetifa, Director-General of di Nigeria Center for Disease Control and Prevention (NCDC), don yan say di issue of accountability and health security for health sector na matter wey concern everybody. He talk dis one for Abuja on Thursday, for di event: Strengthening Accountability for Health Security and Vaccine Equitable Access in Nigeria, wey Health Reform Foundation of Nigeria (HERFON), a coalition of NGOs and media wey dey work to see say di naija government dey accountable as e take concern vaccine and health security to take make we hospitals dey chin chin.
Dr. Adetifa yan say him dey grateful for di chance wey dem give am to yan to di audience and e still hail di organisers for di important work wey dem dey do for di health sector, especially as e concern health security.
Di oga kpatakpata for NCDC yan say kasala fit burst from any community as e take concern health security so make everybody eye dey for ground to take helep support di healthcare system for we kontri.
“We need every community, local government, and state to dey as strong as di Federal government to take manage di problem of our weak health surveillance system. We gats waka enter dis wahala well well and make sure say accountability dey all levels of government, most especially from di local level and di state level wey be di arm of government wey dey control Primary and Secondary healthcare.”
As e relate to di kain care wey we dey get as naija pipo, him yan say di quality of di kain care wey we dey get for di kontri dey tied to di kain resources wey dey available. He also yan say as e take concern pandemic say if anoda pandemic like Corona virus brek out again for we kontri say di health sector dey more kajad to handle di matter better dan di way dem handle Corona.
Health Reform Foundation (HERFON), ogbonge non-governmental organization wey dey chook eye for health betterment for our kontri Nigeria.
Di organization get members for di 36 states for Naija plus FCT, and dia members from both private and public sector. HERFON gum body with Vaccine Network for Disease Control (VNDC) and Gem Hub Initiative (GHI), with support from Africa Health Budget Network organise di event..
Di main aim for di workshop na to join heads together jinja our ability as a kontri to sabi prevent, find, and jinja di health wahala wey dey knack our health sector.