By Olatunde Olaoluwa
Di Federal Government don collect more than six million doses of di Human Papillomavirus (HPV) Vaccine and important supplies for di rollout of di vaccination wey go begin on di 24th of October 2023. Di vaccination go target girls between 9 -14 years.
Dr. Faisal Shuaib, di Oga pata pata of di National Primary Health Care Agency, yan dis one during one press briefing for Abuja on Tuesday. Him talk say over di past several months, di National Primary Health Care Development Agency (NPHCDA), wey dey work hand in hand with di Federal Ministry of Health and partners, don plan well to introduce di HPV vaccine. Say dem don build di skills of frontline healthcare workers, to make sure say dem sabi how to administer di vaccine.”
” Alongside partners and donors, we don secure more than six million doses of di HPV vaccine and important supplies for di vaccine roll out wey go begin on the 24th October 2023.”
Him still talk say di vaccine go helep prevent HPV infection and reduce di wahala of cervical cancer beacuse HPV na common sexually transmitted infection and e dey silently dey show signs of different types of cancers, including cervical cancer.
Dr. Faisal still talk say even though vaccination na di best way to prevent HPV, women still need to dey go for regular screening tests so dem fit detect early signs and start early treatment.