Home Aluta Tori We No Protest Again – Resident Doctors

We No Protest Again – Resident Doctors

284
0

Di Association of Resident Doctors don come out talk say dem don stop di protest wey dem bin plan to do. Dis one dey come after dem di inside meeting wey dem bin get with di oga kpatakpata of di senate on Tuesday.Di Presido of di Asssociation, Nigerian Association of Resident Doctors (NARD) wey him name na Dr. Emeka Orji na him yan dis one.

According by Dr. Orji  dem go review the mata for inside di next 72 hours wey be 3 days wey dey come.Him say “We don go meet senate Presidoo, Majority and Minority Leaders plus di Whip, and dem don agree to di mata wey we bin place for dem table wey make we dey plan to potest for Wednesday.”.

TalkHealth9ja don report am before say di doctors don plan to start di everyday protest, and e suppose start from Wednesday  if di government no meet up with wetin dem demand.

Di decision come after the directive from Federal Government to di Chief Medical Doctors and Medical Directors of Federal Tertiary Hospitals wey be say na “no work, no pay” against the doctors wey dey on strike.Di doctors go strike since July 26, after wey government no fit meet up with wetin dem demand.

LEAVE A REPLY

Please enter your comment!
Please enter your name here

This site uses Akismet to reduce spam. Learn how your comment data is processed.