Home Public Health mata Tuale Everywhere as Ogbonge Journalist Moji Makanjuola Makes History

Tuale Everywhere as Ogbonge Journalist Moji Makanjuola Makes History

943
0
Chief Moji Makanjuola

You sabi Moji Makanjuola for Nigeria Television Authority (NTA)? She na woman wey dey makes news sweet by di way she dey take read am. Ogbonge government through National Centre for Women Development don put her name and photo as one of di ogbonge women for we kontri. She was recognised as “First Female International Health Journalist in Africa” inside Naija Women Hall .

Na First Lady, Sen. Oluremi Tinubu bin open di photo of different ogbonge women inside National Women Development Centre where she name after Maryam Babangida. Mrs Makanjuola na traditional chief for Offa in Kwara State and don win plenty better better awards. She na di Founder of International Society of Media in Public Health (ISMPH)

Plenty people especially members of di Health Sector Reform Coalition dey send tuale and congratulobia messages hive am. All of dem say she deserve di award. Even our oga, Dr. Laz Eze join bodi say Madam Moji too much, make everybody dey celebrate am.

LEAVE A REPLY

Please enter your comment!
Please enter your name here

This site uses Akismet to reduce spam. Learn how your comment data is processed.