Ogbonge public health sabinus, Dr. Laz Eze talk say dis natime for ogbonge govt to show seriousness and strong political will on top sugar tax. He yan dis one as he dey talk during the Gatefield Health Summit in Abuja on 25th July. People dey fear say opposition to increasing sugar tax dey powerful but di TalkHealth9ja boss say nothing pass government to do if dem wan do am.
He yan say di increase of tax on drinks wey get sugar to N30 per litre fit help to reduce how people dey drink am, and help to prevent obesity, cancer, type 2 diabetes and other diseases.
Other sabi people wey follow Dr. Laz talk for the panel na Dr. Pamela Ajayi of Healthcare Federation of Nigeria, Prof. Felicia Anumah of UniAbuja Teaching Hospital and Akinbode Oluwafemi of CAPPA.