E be like say di breeze of New Abia don blow reach di side of medical doctors working inside Abia State as gi state government don komot circular give dem. According by di notice, dem yan all medical doctors wey still wan dey work with Abia State Ministry of Health or Hospital Management Board to submit letter latest 21st July 202.
Tori wey reach us from a govt source dey yan say Abia govt wan transfer medical doctors in di Ministry to hospitals make dem dey treat patients. But e be like say some docs no wan di transfer.