Home Public Health mata Over 10 million Naija Pikins and Women dey Benefit from ANRiN Project...

Over 10 million Naija Pikins and Women dey Benefit from ANRiN Project – Ogbonge Govt.

659
0

Ogbonge government for obodo Naija talk say na 10,766,605 people inside 12 states for we kontri dey enrolled and dey benefit from different micronutrients wey dey help dem body. Dis na di better wey Accelerating Nutrition Results in Nigeria (ANRiN) project bring for we kontri. People wey talk dis on behalf of ogbonge government na Dr. Ojuolape Solanke wey be ANRiN National Programme Manager and Mrs Chito Nelson wey be oga madam for Nutrition and pesin in charge of ANRiN for Federal Ministry of Finance, Budget and National Planning. Na during the ANRiN Annual Results Conference wey hold inside Abuja between 5th and 6th July 2023, dem talk am. Plenty ogbonge sabinus dem for human nutrition matter, senior govt officials from Abuja and project states, plenty ogas from World Bank, NGO partners wey dey help di states for dis project plus tori people.

The beneficiaries include pregnant women, pikins wey never reach 5 years and adolescent girls wey dey lack some nutrients for dem body. The 12 states wey dis project na na Abia, Akwa Ibom, Gombe, Kaduna, Katsina, Kano, Kogi, Kwara, Nasarawa, Niger, Oyo and Plateau. Na World Bank and Global Financing Facility borrow Naija $232 million dem dey use for dis project.

Dem blow plenty grammar during do conference but di summary na say di project don bring plenty benefits to di health of all di beneficiaries, help create jobs for Naija people and growth of local companies wey dey produce micronutrients.

Also speaking at the conference, Dr. Ritgak Tilley-Gyado wey be World Bank Senior Health Specialist and ANRiN Task Team Lead talk say obodo Naija go soon become “destination for nutrition best practices” because of di better better results wey dey show from the ANRiN Project.

We go dey track progress on top dis nutrition mata.

LEAVE A REPLY

Please enter your comment!
Please enter your name here

This site uses Akismet to reduce spam. Learn how your comment data is processed.