Better tori dey for Bodi-mata Advocates as Ogbonge Govt don ready to increase health budget to ten per cent of overall 2024 budget. Na Dr. Salma Anas Ibrahim wey be Special Adviser to Presido Tinubu on Health Talk dis one, Tuesday, during Gatefield Health Summit. She also don talk am before during di Stakeholders Health Financing Roundtable wey Health Sector Reform Coalition bin organise recently.
More so, she say di health sector need show capacity say dem go fit use di money finish to solve plenty bodi-mata problems.