Home Uncategorized Foundation Don Sama Eight Healthcare Workers Award for Abuja

Foundation Don Sama Eight Healthcare Workers Award for Abuja

187
0

Eight healthcare workers wey dey work for AMAC, Bwari, Gwagwalada and Kuje Area council for inside Abuja, don collect award for di ogbonge work wey dem dey do.
Dr. Aminu Magashi Foundation with support from di Heroic Discovery and Community Development Center (HEDCODEC), na dem sama di award on Thursday for Abuja

According by di coordinator, Africa Health Budget Network (AHBN), Dr. Aminu Magashi di award na to take celebrate di ogbonge work wey this eight health workers dey do and to take ginger others make dem do beta. Dr. Magashi yan say him plan na to make dis award make e be national mata to take reach plenty oda healthcare workers wey yakpa for obodo naija becos e no be beans to dey for front dey helep save people live.

Di executive director of HEDCODEC, Mr Kabir Abddulsalam, follow yan sa dem sama dis eight people di award for dem ogbonge work and to take call kontri pipo make dem follow see di importankpa wey e dey to dey rub healthcare workers hands for back as na dem be the rock wey we healthcare system dey stand ontop chim chim.

Ms. Iyabo Omotoke Balogun wey be Family Planning Provider, Kuje, PHC and one of di awardees come carry plenty tuale drop for di domot of di organisers of di award for di recognition wey am plus di oda seven odas.

For him remark, di chairmoo of di National Advocate for Health (N4AH), Hon. Muhammed Usman carry plenty hailings give di eight healthworkers say make dem continue with di good work wey dem dey do.

LEAVE A REPLY

Please enter your comment!
Please enter your name here

This site uses Akismet to reduce spam. Learn how your comment data is processed.