Home As e de hot Carry Di N500b Palliative Moni Give Health Insurance to Kontri Pipo – ...

Carry Di N500b Palliative Moni Give Health Insurance to Kontri Pipo –  Group Beg Presido Tinubu.

886
0

Di  ogbonge bodi mata group, Health Sector Reform Coalition (HSRC) don call on presido Bola Ahmed Tinubu to use di N500 billion palliative moni give health insurance to at least 10 million households wey go cover about 60 million Nigerians.

Mrs. Chika Offor, the chairmoo for di group plus oda membas of di group na dem make di call  for inside Abuja.

TalkHealth9ja report say Presido Tinubu bin ask di House of Representatives to amend di 2022 Supplementary Appropriation Act to give N500 billion as support for kontri pipo ontop di commot wey dem commot subsidy. 

Tinubu wan commot di N500 billion from inside di N819,536,813 supplementary budget wey forma presidio Buhari bin submit to di National Assembly.

According by Mrs. Offor, if di goment do am, e go catapot di health insurance wey dey cover onli 17.8 million Nigeians (8.5%)  to 77.8million Nigerians (37.4%), a 337 per cent increase for national coverage inside one year.

She follow yan say NASS members fit dey buy health insurance for dem constituents through dem constituency projects and to revisit di National Health Act 2014,  move di Basic Health Care Provision Fund (BHCPF) funding from di Consolidated Revenue Fund (CRF) to Federation Account Allocation Committee (FAAC) and incresam to at least 2%

”Make di organised private sector take some percentage of dem Corporate Social Responsibility (CSR) funding put for health, dis go contribute  to di vulnerable group funds wey dey inside di  National Health Insurance Act (NHIA)”. 

“E dey very importankpa say country pipo sabi wetin dey inside di Patient Bill of Rights wey di Federal Competition and Consumer Protection Commission (FCC) plus di Federal Ministry of Health produce becos e go make sick people get respectful and accountable treatment”

She also yan say di coalition get strong believe say beta funding for health sector go follow helep to make we health care delivery dey chim chim.

LEAVE A REPLY

Please enter your comment!
Please enter your name here

This site uses Akismet to reduce spam. Learn how your comment data is processed.