Home As e de hot Bodi Mata na our di main di main – SA to Presido...

Bodi Mata na our di main di main – SA to Presido on Health

510
0
Dr. Salma Anas Ibrahim at the Gatefieldhealth summit held on Tuesday the 25th of July 2023


Di Special Adviser to President Bola Ahmed Tinubu, Dr. Salma Anas Ibrahim don yan say the ogbonge mata wey dey make the president dey count ceiling for night when him suppose dey sleep na bodi mata issue
Dr. Salma Anas Ibrahim yan this one for the GatefieldHealthSummit wey take place for Abuja on Tuesday. The Summit bring bodi mata sabinus from all over the kontri to yan how dem go take make we health sector kajad and to also join head together yarn wetin government suppose do to take comot plenty body mata expenditure from country pipo. Another ogbonge mata wey the summit been cover na how we country go fit increase Sugar Sweetened Beverage tax from the 10 naira wey e dey now to at least the 20% (N30 per litre) wey Obodo world body matter organisation (WHO) recommend.

Dr. Salma also yan say the Presido Tinubu administration dey ready to increase money wey dey go to health inside the annual national budget to 10%, level wey we country never reach since Abuja declaration of 2021. Abuja declaration yarn say make every country for Africa dey allocate at least 15% of them national budget for health.

Over consumption of sugar drink na major risk factor for disease like diabetes, obesity, tooth decay plus including plenty others, the SA yarn say she go work with the civil society to take see say them achieve them request.

LEAVE A REPLY

Please enter your comment!
Please enter your name here

This site uses Akismet to reduce spam. Learn how your comment data is processed.