Di join bodi of medical doctors for obodo Naija (Nigerian Medical Association) don use serious vexation dey para on top di killing of Dr. Uyi Iluobe in Oghara, Delta State. Tori from NMA suggest say one patient wey carry gunshot injury die for di hospital, and people wey carry am come use vex kill di medical doctor wey own Olive Clinic Oghara-Eki.
NMA say dem shock as Naija people don begin dey kill di small number of doctors wey remain for we kontri. According by di statement wey their Presido Dr. Uche Ojinmah sign, NMA wan make di government find and punish the killers with immediate alacrity.
See as NMA take write di tori…