Medical doctors all over obodo Naija dey vex and cry over di killing of dem colleague, Dr. Uyi Iluobe wey own Olive Clinic, Oghara in Delta State by relatives of a patient. Yesterday, Naija Medical Association (NMA) don komot message tell government to find and carry im killers go court immediately make dem get justice.
Tori wey reach us today na say all doctors wey dey work inside Delta State go siddon for their house for one week to cry and pray for the repose of di soul of Dr. Uyi. Dem say their head no correct again as fear dey catch dem to even go work. Plenty medical doctors wey dey react to di tori of Dr. Uyi’s death say na to japa komot for Naija be di way out as government dey punish dem and patients relatives don begin dey kill dem.
Di people wey kill Dr. Iluobe been dey react to di death of their patient wey die inside I’m clinic with gunshot injuries. We go dey provide update for dis tori as we hear am.