Home As e de hot Women too dey suffer! – WON

Women too dey suffer! – WON

231
0

Women Optometrists don advise women for dia conference and gala wey dem title, ‘The empowered woman,’ make dem make sure say dia health tanda well in every level, whether na mental, physical, psychological, and spiritual health.

Di Presido for Women Optometrists in Nigeria association, Dr. Ogechi Nwokedi, explain say dia theme wey be ‘The empowered woman,’ dey put eye for issues wey concern women, how dem go fit use dia potentials and solve dia problems even as dem dey still do día professional work.

She still continue say dem come together to network, learn, share knowledge, relax, support diaself, and breathe fresh air because even tho women dey face plenty palava for life, dem still dey handle am well well.

Consultant Neuropsychiatrist, Dr. Maymunah Kadiri, also stand come advise make women open día mind to collabo and know when dem go tell person no even if di person dey force dem.

LEAVE A REPLY

Please enter your comment!
Please enter your name here

This site uses Akismet to reduce spam. Learn how your comment data is processed.