Ogbonge medical doctor wey dey lead campaign to make hospitals inside obodo Naija function kajadly, Dr. Laz Eze, don give explanate on why he wrote a new book on things wey people suppose dey do to make hospitals work kajadly. He talk say na because of di good results he don see inside communities wey get health committees and to answer plenty questions people dey as am. Dr. Eze wey be our oga for TalkHealth9ja talk say di boom na for everybody to read because na kontri man grammar he use write am.