Di National Agency for Food and Drug Administration and Control don yan say dem go put dia armour to hunt di people wey dey produce and sell bleaching creams.
NAFDAC yan say abuse for cosmetics fit cause damage to internal organs for di body.
Di acting Director-General for di agency, Dr. Monica Eimunjeze yan for di workshop wey NAFDAC collabo with Association of Nigeria Health Journalists to organise for Abuja say make naija people no dey use bleaching creams because di creams dey carry mixtures wey dey very bad to di body.
Eimunjeze reveal say no be only for naija dis matter dey disturb, but for di whole world.