Di National Agency for Food and Drug Administration and Control reveal say dem seize knackology drugs were no dey registered and some wey don expire plus other drugs wey reach N20m when dey burst 26 shops inside Sabon Gari market, Zaria LGA inside Kaduna State.
Di agency been yan say di seizures na microgynon wey be drugs wey dem suppose dash free to Internally Displaced Persons and oxytocin wey be injection for women wey don born and even tho di drugs suppose dey for special type of temperature but dem drop am anyhow for outside.
Di Deputy Director wey dey in charge of Investigation and Enforcement Directorate of NAFDAC, Kaduna Office, Tamanuwa Andrew, open up say di agency put dia full armour to make sure say dem fish out troway fake drugs.
He point out say fake, expired, and substandard medicines na very big palava for di world especially Naija wey just dry develop.