Home As e de hot We don approve beta prostrate treatment – EU

We don approve beta prostrate treatment – EU

244
0

Di European Union don stamp, approve new treatment wey go fight very high type of prostate cancer by Novartis wey be big Swiss pharmaceutical giant.

Dem don give treatment wey dem call Pluvicto carry go for adult patients wey get metastatic castration-resistant prostate cancer.

Novartis yan say new cases of prostrate cancer for di world pass 1.4 million with 375,000 deaths for 2020 and na mostly men for 112 countries been dey get am more.

Health authorities for United States been approve am for March and Britain and Canada come give dia own carry go approval recently.

Di European Commission approve di treatment for patients wey don collect other anti-cancer treatments including androgen receptor pathway inhibition and taxane-based chemotherapy.

Dem base di approval for a phase III trial with 831 patients after dem find out say di treatment reduce di risk of death by 38 percent more than di other treatments wey don dey already.

Di Swiss giant reveal say dem still dey test di treatment to use am dey treat early stages of prostate cancer.

(AFP)

LEAVE A REPLY

Please enter your comment!
Please enter your name here

This site uses Akismet to reduce spam. Learn how your comment data is processed.