Home As e de hot Uganda don collect free vaccine to fight Ebola – WHO

Uganda don collect free vaccine to fight Ebola – WHO

190
0

Uganda don collect free 1,200 doses of Ebola candidate vaccine against the Sudan Ebola virus, 79 days after dem déclare di outbreak as di World Health Organisation tok am.

Di WHO Africa region point out say University of Makerere go join hands with Ministry of Health, Uganda, and di WHO to do clinical testing first first.

Uganda been declare outbreak of Ebola disease, caused by the Sudan virus on September 20, 2022, after dem confam am for lab result of one patient from village inside Madudu sub-county, Mubende district, central Uganda.

Ministry of Health, Uganda reveal say by November 30, di outbreak don infect more than 142 people come kpai 56 and 4,691 dey for contact list wey dem go follow up.

LEAVE A REPLY

Please enter your comment!
Please enter your name here

This site uses Akismet to reduce spam. Learn how your comment data is processed.