Diet experts don tok say social media dey influence people mind on wetin dem dey eat, dey loud am say online platforms dey give parents wrong format for food for naija.
E dey reported say social media dey corrupt people dem mind for family nutrition and e dey increase malnutrition for di country.
Experts for this kain thing don talk am say e fit no be say raba no dey na im dey make small pikin dem dey suffer from malnutrition.
The real problem na say people no sabi how to dey diet and the type diet wey dem suppose dey give pikin dem.
E report say no be only poor children dey war malnutrition, but the rich man pikin also dey kiss this wahala cause dem parents dem, dey use social media dey select dem food.
Registered dietitian Nutritionist for Alex Ekwueme Fedral Teaching Hospital, Abakaliki, Ebonyi state, Nwabumma Asouzu, say no be say food no dey, but na wrong food choices dey cause malnutrition.
Asouzu still play d tape say na social media dey brainwash parents.
Informate for social media don format people dem brain and informate wey dey dey día fit no dey correct. So wrong food choices, increasing portion sizes and mumu eating na im dey cause this malnutrition.
E dey stated say even the rich man pikin dey suffer malnutrition and no be only poor man pikin.
Asouzu still yarn say malnutrition dey two type, undernutrition and overnutrition wey be say na macro-nutrients deficiency i.e inadequate diet dey cause am.
Anoda one na micronutrient defficiency wey dey hidden and dey affect growth and development.
United Nations Childrens Fund been sound the alarm on thursday say Naija dey loose at least 100 children every hour i.e 2,400 kpai-kpai dey occur on a daily basis.
UNICEF’s chief Nutrition Officer for Naija, Nemat Hajeebhoy loud the mata wen she been dey get interaction with media executives, come talk say one third of children in nigeria been dey live for food poverty, plus say the first 1000 days for man pikin life dey open wey e be say undernutrition fit dey prevented.