Doctors don reveal say Brazilian football legend wey be Pele don dey get better for health even tho say dem never tok when dem go release am as him don dey hospital for like 2 weeks now.

Pele, 82, wey people dey see as di number 1 ogbonge footballer for life been land hospital for Sao Paulo on November 29 as him team tok say na re-evaluation of his chemotherapy treatments dem dey do because him dey collect am since before him do surgery to comot colon tumor for September 2021.

Doctors also find out say him get respiratory infection even tho say him don dey improve.

Him daughters wey be Kely Nascimento and Flavia Arantes Don tell fans make dem no worry dia head because dia papa dey very stable and him no dey for end-of-life care.

LEAVE A REPLY

Please enter your comment!
Please enter your name here

This site uses Akismet to reduce spam. Learn how your comment data is processed.