Home As e de hot Only 10,000 doctors remain for naija – NMA

Only 10,000 doctors remain for naija – NMA

164
0

Naija Association of Medical Doctors don yan say doctor dem don dey small for naija on steady, plus say 10,000 beta doctors don japa.

President wey dey carry the association for head wey be Dr. Emeka Orji naim loud am.

Im still say 100 doctors dey japa to anoda country wey pasture green.

Im talk am say him know say even now dem just get about 24,000 doctors and consultants, medical officers house officers and resident doctors dey inside am.

For the 80,000 doctors dem wey dem register, say 64% no dey service.

Some don japa, some don find anoda work some don retire and some don kpai.

Di resident doctor dem been dey 16,000 but now dem dey waka for inside 9,000 to 10,000.

We no fit sabi the figure cause dem dey japa everyday.

So we get normal 9,000 to 10,000 resident doctors for inside the country.

In total we get 24,000 doctors and consultants,resident doctors, medical officersand house officers.

Di WHO put am one doctor to 600 patients but now for naija na one doctor to 10,000 patients.

NARD say reason for the japa wey dem dey do na poor renumeration, poor welfare and lack of housing schemes.

LEAVE A REPLY

Please enter your comment!
Please enter your name here