Medical people dem don warn mothers dem wey get big head wey no dey hear word, say if dem continue dey give dem pikin excess vitamin, life no go balance for their health.
Dem say as pikin dem dey swallow excess Vitamin A e fit cause brain damage or convulsion.
Dem talk say wetin samll pikin dem need to grow na proper nutrition no be dietry supplements.
Mayo clinic talk say as dem dey take high doses of vitamin A supplement , e fit damage dem liver.
Physicians dem been loud this intel for exclusive interveiw with PUNCH Healthwise, as dem dey beg parents dem make dem dey see pikin as human being no be diseases.
Olgbenga Mokuolu, wey be professor of pediatrics for the department of pediatrics,college of health siences, university of ilorin say except say dem dey sick, pikin dem no need routine nutrition supplements.
Prof. Mokuolu,wey still be consultant pediatrician for Univeristy of Ilorin Teaching Hospital, yarn say e dey wrong to dey give multivitamin to improve dem appetite.