Di National Drug Law Enforcement Agency don put name of teenager, Abdullahi Aliyu, for paper say him be drug trafficker for Federal High Court inside Lagos.
Dem reveal say dem catch Aliyu wey dey 19 years old with 1.2kg of Tramadol, 32g of Rophynol and 2kg of Diazepam.
Di lawyer for NDLEA, Mr. Lambert Nor, write for di charge sheet say Aliyu been commit di offence on October 13 for Alaba Rago market area of Ojo, Lagos State.
Di five counts charge wey dey against Aliyu come be “illegal peddling of restricted narcotics,” as Nor tok say e dey“contravened to the provisions of Section 11(c) of the NDLEA Act Caps N30 Law of the Federation 2004.”Reports from NAN show say Act go bring penalty of life imprisonment for an offender if him dey guilty tho di court never fix date.
(NAN)