Di Health Sector Reform Coalition (HSRC) been organise Townhall meeting to mark di Universal Health Coverage (UHC) Day on Tuesday, 13th December 2022 inside Abuja.
Every 12th December na when di world dey celebrate Universal Health Coverage (UHC) and di theme dis year na “Build the world we want: A healthy future for all.”
Di convener wey be Mrs Chika Ofor, for her opening remarks yan say even as naija follow dey celebrate Universal Health Day, naija people no fit afford beta basic Healthcare.
Mrs Ofor wey be di Chairperson, HRSC, say di event na townhall meeting so everybody wey come go tok wetin be dia problem for health sector and how to solve am.
She still yan say she don see and get experiences on how people dey kpai anyhow because no fit pay for health from people wey she know and she don tire.