One laboratory scientist, Dr. Donald Ofili don yan say laboratories no suppose dey inside estate where people dey live because dem dey carry Infectious materials.
Dr. Donald Ofili wey be Director and Deputy Registrar, MLSCN Accreditation Service Abuja, still tok say no be everywhere laboratories suppose dey because di kain things wey dem dey pathogens, chemicals and equipment wey dem dey handle inside día fit cause problem for people outside. Ofili reveal say Federal Government dey arr age policy wey go make sure all di lab for naija dey approved by 2025 and anybody wey wan open lab go follow di files wey dem get already. He still warn say even before person wan start to dey build lab, make him register am so him no go get problem.