Stakeholders for healthcare services don beg make government for all di level start to dey implement di family planning policies so dem go fit improve for di country.
Dey yan dis one as dem get meeting for Abuja before di 7th Nigeria Family Planning Conference wey go happen from December 12-16, 2022 and di theme na ‘Journey to 2030: The opportunities ahead.’
Di chairmo for di Association for Advancement of Family Planning and NFPC, Dr. Ejike Oji beg make government put policies wey go stand for family planning.
He tok say dem dey happy because government don launch di national policy and dem still go put one percent of health budget money for family planning from both federal and sub-national level.
He also reveal say as di National population commission go get dia census next year, e go help give dem ogbonge data.
But then, make government make sure say dem dey put things in place wey go help men and women get access to better family planning services to help día family.