Health experts don beg naija people wey go just wake up see say dia navel don dey grow, make dem no ignore any pain at all for dia belle area because e fit be sign for umbilical hernia.
Dey explain say umbilical hernia dey happen when di things wey dey inside di abdomen, di intestine, pour out inside di navel and e go become worse if di intestines dey trap.
Di experts come explain say e dey happen if dey born pikin, cut umbilical cord but e no close well so e go start to dey pain di pain when di intestine start to dey ouch himsef out and di person belle go just dey big still dey pain am.
Dey also yan say e fit also join hands dey cause other pain for body like pregnancy, weight lifting, and weakness of di walls for di stomach.
Mayo Clinic reveal say dem dey born many pikin with umbilical hernia, even tho di condition fit still just come when di person don grow and na mostly women dey suffer am.
One main sign for di condition na when di navel just dey big anyhow and e dey show for most pikin if deya tart to dey cry.
Di clinic still point out say most of di umbilical hernia dey close when di pikin reach like 1 year or 5 years but if e happen when di person don grow, e fit need surgery.
Di experts, Prof. Lukman Abdur-rahman wey be paediatric surgeon for di University of Ilorin Teaching Hospital, and Dr. Stanley Egbogu also point out say if person dey always get dat pain for navel, make dem go hospital sharp sharp because e fit be emergency.
Di experts still tok say no be everybody wey dia tummy big get di condition, so if e no dey pain di person, make dem just dey live dia life dey go.