Home As e de hot HIV/AIDS: coverage for mama-pikin transmission dey low.

HIV/AIDS: coverage for mama-pikin transmission dey low.

166
0

National co-odinator of Association of people wey dey live with HIV and AIDS for Naija, Assumpta Reginald don talk say uptake for antenental care, facility delivery and early infant diagnosis coverage for human immunodeficiency virus dey very low.

Reginald still put am say low uptake for facility based services by mama dem no dey peculiar to women wey dey live with HIV and AIDS.

Reginald talk on thursday for abuja for advocacy workshop as dem dey mentor mama dem via di prevention of mama to pikin transmission of HIV and early infant diagnosis[EID] services, and 16days for activism plus dem close out ceremony for four days training wey ASWHAN been organise and funding support by UN women.

She talk say she dey aware say the ongoing national strategic plan dey move forward to the elimination of mother to child transmissions for HIV.

She say na good development but dem still dey far from the vision.

Im say the low uptake for facility based services from mama dem no dey peculiar to pino pino dem wey dey live with HIV.

National data wey women dem dey use for the facility dey reflect say as e dey sup for women wey dey live with HIV, na so e dey sup for Naija.

LEAVE A REPLY

Please enter your comment!
Please enter your name here

This site uses Akismet to reduce spam. Learn how your comment data is processed.