Home As e de hot Health tourism don swallow our money finish! – CBN

Health tourism don swallow our money finish! – CBN

203
0

Reports don show say Naija don spend $6.23m for foreign healthcare services from January January reach August 22, 2023.

Na Central Bank of Nigeria drop dis report to show how much di country don spend on health mata and social services under sectoral utilisation for transactions wey dey for foreign exchange.

Di report show say Naija spend $0.17m on foreign health-related services for January while dem spend $0.14m for February and e dey increase for March and April reach $0.43m and $3.02m respectively.

Di CBN report also show say di country spend $0.79m inside May and e drop to $0.42m for June, still come rise for July at $0.46m and reach $0.80m inside August.

Dis report show say di money wey run comot dis eight months dis year for health tourism dey more than wetin di country spend di same time for 2021 for health tourism – $1.47m.

Stakeholders on dia own part don dey cry say dem no dey fit access for ex make dem do importation and manufacturing of essential medicines.

LEAVE A REPLY

Please enter your comment!
Please enter your name here

This site uses Akismet to reduce spam. Learn how your comment data is processed.