Home As e de hot Females wey get disability dey face more GBV – TLMN

Females wey get disability dey face more GBV – TLMN

253
0

The Leprosy Mission Nigeria don reveal say women and girls wey get disabilities dey face more gender-based violence, sexual abuse, neglect, maltreatment, and exploitation more than others.

Di group also pint out say di main established gender-based violence referral pathways no dey for di persons with disabilities as di culprits continue dey do wetin dem like with dem.

TLMN yan dis obe as di 16 days of activism dey go on plus di international day for persons with disabilities wey carry di theme ‘Unite! Activism to End Violence against Women and Girls and the year 2022 International Day of Persons with Disabilities: Transformative Solutions for Inclusive Development,’ and dem join hand with Disability Rights Advocacy Center organise am.

Di gender adviser for TLMN, Stella Udobong said yan say 2 inside every 3 women for naija dey face some form of violence for dia lifetime but di women and girls wey get disabilities, dem dey face ‘disproportionately high rate’ of gender-based violence, sexual abuse, neglect, maltreatment, and exploitation.

LEAVE A REPLY

Please enter your comment!
Please enter your name here

This site uses Akismet to reduce spam. Learn how your comment data is processed.